Verse 1
Wetin I for do, who I for call o
If e no be You, how I for run o
Papa o, na You rescue me e e e
No money for pocket
No food to eat
My shoe na so so alignment, no house to sleep
You come rescue me
That’s why You be my hero
Chorus
Oh na only You be my Hero
Na on only You I go follow
Why You love me so…
Even when I don loose hope
Everybody give me long rope
You come rescue me
That’s why You be my hero oh
My Hero, My Hero, My Hero oh
Verse 2
Na so dem dey call me mumu
Their mouth dey chop me like fufu
Dem yab, dem laugh me, reject me, eject me
Dem even say I no go school
Thank You baba u no dey look face, thank You
Baba You no get two face, na You rescue me
That’s why You be my hero.
Chorus
Oh na only You be my Hero
Na on only You I go follow
Why You love me so…
Even when I don loose hope
Everybody give me long rope
You come rescue me
That’s why You be my hero oh
Bridge
I dey lonely, only me
You come love me
Come lift me
My spirit, my soul, take control,
my heart and My love
My hero oh…oh…my hero
Bridge
Them go reject me, eject me, dem wound me
Dem wan kpai me, dem no know say na
Because of You i still dey o!
Refrain
Na only You be my hero
Na only You I go follow.
Why You love me so?
I never know
Song by Tim Godfrey